Homepage About us  
 

NA BEG I DEY BEG O!

By Henry CHANDY A.

E-mail: henrychandy@yahoo.com08076005022

De thing wey happen to U.S.A for Sydney 2000 Olympic suppose don teach plenty people lesson.

U.S.A for every Olympic always de-do well. Dem follow de dey on top of medal table as dem for almost all de event wey dey for Olympic.

Today, U.S.A athlete dem don rub shit for dem people face. Sydney 2000 Olympic don helep us to open dem yansh as people wey de use jipity win dem medal.

De first one wey International Olympic Committee 10C people discover na U.S.A fastest woman for dat year Marion Jones wey dey for prison now becos of say she don gree say she use drug to run all de race wey she take win plenty gold medal for Sydney Olympic.

I thank God for people wey bring de idea say make dem de- test de piss and blood of de athlete dem after dem run finish.

If no be so, people like U.S.A athlete dem for still de-cover our eye and receive our praise as people wey de-do well pass other country dem.

De one wey surprise me be say de U.S.A athlete dem de-even take another medicine wey de-cover de drug wey dem don swallow before to make am hard for de people wey de do de test to know wetin de happen.

I know how Marion Jones test take hard doctor dem until she come finally use him mouth convess say she really take drug run for Sydney 2000 olympics.

Today, de American sisi don de smell rod for one prison for U.S. so. Dem say she go dey there reach six month, and becos of dis matter, de 10C people wey de-organize Olympic don agree to collect all dem medal from de sisi and give back to de people wey she run pass for dat Olympic. For dat one, Naija de expect to collect one medal from de sisi hand.

Again, we hear say another U.S.A men team wey run 4*100m race for de same Olympic for Sydney also take drug before dem run de race and win gold medal for am. Dem say two people wey follow run dat race swallow drug wey de helep give person more power and becos of dat, too, 10C people don decide to collect back dem gold medal from de team and give to de people wey come second wey be Naija.

Shebi una see wetin jipity fit cos a whole country?

Now, Popular side de beg our people wey dey Beijing make dem shine dem eye and no bring shame to us o. Una bye-bye.

 

 

 

Super Sport Worldwide
 
Copyright 2006.All right reserved.Any duplication of our news or document in any format is against the law.Site liscence by champion newspapers.Powered by NigeriaNet